Govano of Imo State, Owelle Rochas Okorocha don tel sekuriti pipul fo Kano mek dem waka shap shap go faind di bad bele pipul wey kil Madam Bridget.
Okorocha say tru tru, dis Madam Bridget Agbahime wey dem du eni hau go kil am fo Kano na Imo woman from Mbaitoli Local Govament o.
Di govano tel Kano sekuriti pipul mek dem put aiz fo graund tochlait di mata so dat evribodi wey get hand insaid dis badness go go ansa fo dia wikednes.
Im kom tel Imo pipul wey dey Kano mek dem kul dia tempa as govament dey tochlait di mata fo dat ples.
Im stil tok se nobodi get eni rait to go tek anoda pesin laif eniwia fo dis Naija.
Afta ol dis wan, Okorocha heil govano Ganduje fo di akshon wey im don ouredi tek on top di mata.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.