Niu Manchester United manija, Jose Mourinho go giv dem Premier League taitul insaid 2 yiez. Na so difenda Ricardo Carvalho tok o.
"Jose get somting to pruv afta wetin bin hapun fo Chelsea." Na so Carvalho wey don ple fo Chelsea, FC Porto, and Real Madrid rait fo The Sun niuzpepa
"A biliv se im go mek Man U beta. In di nes 2 yiez, im go mek dem champion, " na wetin a dey see bi dat.
Carvalho biliv se Mourinho wey don win Premier League 3 taim get somting to pruv afta wetin bin hapun to am fo Chelsea di last taim.
"Im na korekt koch. Nau im don kom dey fo ogbonge Klob. United na wan of the ogbonge klob fo futbol.
"A no get eni fia se im go win meni trofi fo United and im go mek dem champion agen.
"A no nou weda na fo di 1st yie, di 2nd yie ou di 3rd wan, bot Mourinho go win taitul agen. Mi a dey predict se na di 2nd yie im go du am."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.