Monday, June 6, 2016

Tom Polo don ron enta Libya

Bifo bifo militant lida fo Niger Delta, High Chief Government Ekpemupolo aka Tompolo don waka from Naija go enta Libya o.

Na wan militant grup wey kol diasef Joint Niger Delta Liberation Force, JNDLF tok dis wan on Monday o.

Di JNDLF kom dey mek maut se "Naija militri no fit faind Tompolo bot wi sabi wia im dey nau."

Na dia komanda dem wey bi General Akotebe Darikoro, Commander, General Duties, General Torunanaowei Latei, Creeks Network Coordinator, General Agbakakuro Owei-Tauro, Pipelines Bleeding Expert and General Pulokiri Ebiladei, Intelligence Bureau of JNDLF, join bodi tok dis wan o.

“Tompolo dey fo Libya bot wi go get am, weda im dai ou im dey alaif as im folo awa bak go dey sopot Naija govament. "

JNDLF stil kom tok se “Naija militri no nou dia wok. Na im mek dem neva sabi hau wi dey opret. Di onli tin wey dem sabi na to kari AK47 dey haras pipul and to dey du bai fos minimini wanawana wit smol smol girls and wuman dem."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories