Monday, June 6, 2016

Drink yo oyel mek wi chop awa yam

Na wa o. Si di kain tin wey Arewa man dey tel Niger Delta pipul.

Sineto Joseph K N Waku wey bi strong memba fo Arewa Consultative Forum say di tin wey Niger Delta pipul dey du dey veks am nor bi smol.

Im kom ask wan kweshon say "bifo oyel moni kom mek Naija pipul lezi, nor granot wit cocoa and pam oyel moni evribodi bin dey chop?"

Waku kom chalenj Niger Delta pipul say; "wi don chalenj dem fo Benue bifo. Mek una drink una oyel, mek wi chop awa yam. Mek wi si hu go sovaiv."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories