Govano of Taraba State wey bi Darius Ishaku don tok se no taim wey im diskos grezin land wit enibodi o.
Ishaku tel niuz tori pipul se dat tok wey Minista of Agriculture tok se Taraba donet 55,000 hectares of land fo grezin nor bi tru o.
Sylvanus Y Giwa wey bi Senior Special Adviser on Media Matters to Govano Ishaku olso put maut fo di mata.
"Taraba State govament won tok am mek evribodi hie se wi want mek famas and herdsmen dey du dia oun biznes fo Taraba witaut eni wahala bot i go gud mek fedral govament and stet govament join bodi arenj di mata wel wel."
Na fo wan okeshon fo Abuja wey di Minista of Agriculture and Rural Development, Audu Ogbe, tok Adamawa, Gombe, Plateau, Kaduna, Katsina, Kano, Taraba, Niger, Sokoto, Jigawa and di Federal Capital Territory, Abuja don donet 55,000 hectares ich to fedral govament wey herdsmen go dey yuz feed dia cattle.
As Govano Ishaku hie di tori, im kom veks. "I nor get eni taim wey enibodi kom hia from fedral govament say dem won diskos grezin mata. Hau dem go tok se Taraba donet 55,000 hectares?"
Ishaku kom tel Taraba pipul to go slip wit dia 2 aiz as im neva promis to giv dia land to enibodi fo grezin.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.