Friday, June 10, 2016

A no nou se a get bele wen a dey praimari 6

Popula Nollywood aktres, Rita Edochie tok last wik fo Abuja se shi get bele di taim wey shi dey fo praimari 6 bot shi no ivun nou.

Edochie tok fo di intaviu wey shi grant se shi no tel ha mama abaut di bele bikos shi no ivun nou se shi kari bele.

"A no fit tok hau di tin hapun, bot wan boi yuz juju kom slip wit mi.
"A no nou se a don get bele. A jos dey smol.

"Wi dey ple gem fo skul wan de. Dat kain gem wey bi se if refri say "number one", children wey hold di nomba 1 go ron go kolekt somtin.

"As wi de ple di gem, na im mai klasmet kom insolt mi say mai bele dey laik breadfruit. A kom veks bit am well well."

Shi tok se afta di fait na im di tisha tel dem to go bring dia perent dem.

"As a rish haus kom tel mai moda wetin hapun fo skul, na im shi say mek a kari mai dres op.

"Mai moda kom ask mi, "yu nou se yu get bele?"

"As a hie dis wan, na im a jos fent."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories