Mr Desmond Nunugwo wey dem tok say im du pesin wayo don dai fo EFCC hand onli 6 awas afta dem diten am.
EFCC tok tok pesin, Wilson Uwujaren tok dem arest Nunugwo on Thursday but after smol taim di man kom dai.
Uwujaren tok say di hospital wey dem rosh Nunugwo go afta im komplen se i get as bodi dey du am na dem konfam se di man don dai o.
"Dem say Nunugwo yuz wayo kolekt N91m from sombodi afta im don yan am say som big biznes men from Dubai wey bin won bai Nicon Insurance go help ha stokfish biznes.
"As di wuman waya di N91m into di akaunt wey Nunugwo bin giv am wey bi Mainagge General Merchants fo Diamond Bank, na im Nunugwo bigin doj am o. Bikos of dat wan, di wuman go ripot di mata to EFCC.”
“Na wetin mek EFCC go arest Nunugwo fo Utako, Abuja araund 5:33pm on Thursday, June 9, 2016 bi dat o. Wi kom tek im stetment wia im admit se im kolekt di moni from di complenant. Di man ivun tok se im don waya N30m aut of di moni to Norway. But im no fit tok wia di balans of N61m dey.
“Araund 7:30pm na im wi diten di sospekt as nobodi kom bel am. .
“Afta 6 awas, di man bigin krai se i get as i dey du am. As wi rosh am go hospital, dem kom konfam say di man don dai o."
Uwujaren stil tok se as di man don dai, dem don ripot fo Wuse polis steshon wia dem go tochlait di mata.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.