Di Joint Revolutionary Council, JRC, of di Joint Niger Delta Liberation Force, JNDLF on Friday tok se eni govano fo Niger Delta we sho bad bele fo dia strogul go hie nwii.
Na insaid di stetment we JNDLF Commander, General Duties, General Akotebe Darikoro, and 3 odas bin riliz to eksplen wai dem kansul di missile we dem bin tok se dem go faya na im dem dro dia govano dem iez o.
JNDLF don gri se dem go tok wit fedral govament bot dem get dia oun sevun point dimand we bi se if dem get am, dem no go skata paiplain agen.
“Wi go tok wit govament if dem redi to giv os wetin wi want. Awa govano dem and oda pipul we go riprezent os dia nou se dem no fit du eni hau.
"If dem du eni hau, wi go tek dia aiz si pepe. Dem nou wetin wi fit du and dem no fit haid from os."
Our representatives for the dialogue, especially the governors and others will not betray our demands with the federal
government. Any betrayal on their own part shall be viewed as betrayal of the entire region and we shall go after them immediately as they know our mode of operation in which they will not escape from us.”
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.