Dat wuman we bon pikin we bi se di hat de autsaid di bodi don tok se shi bin tink se na twins shi bon o.
Falmata we bi 24 yiez old moda of 4 pikin tok se as shi si ha pikin hat de raiz and fol autsaid di chest, shi kom tink se shi don bon twins.
Na fo Gaidam lokal govament fo Yobe State shi bon di pikin bot dem don transfa dem to University of Maiduguri Teaching Hospital.
Falmata tel niuz tori pipul se shi no nou wetin bi antinatal as dat kain tin no de dia vilej.
Bot ha hosband Mustapha kom tok se wumen fo dia vilej no de gri go antinatal bikos dem no want men to si dia bodi.
Eniwe, Mustapha kom tok agen se di onli klinik we nia dia ples rish laik 10 kilomita from dia vilej and dem no de eva get medisin fo di ples.
As di tori kom de nau, di dokto dem we go du opreshon fo di pikin bodi to put ha hat insaid ha chest wia i sopoz to de tok se na N2m to N3m na im dem go kari du di wok.
Nau, Mustapha na vilej fama and na onli 10 to 15 bag of corn, rice, millet and Guinea corn dem im de get fo im fam evri yie. Hau im go manej get ol dis moni?
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.