Wan Grade 1 Area Court fo Dutse, Abuja don send wan student wey im nem bi Emmanuel Usman to 2 yiez in prizin.
Di ofens wey kari dis 17 yiez old boi wey dey liv fo SCC Road, Bwari enta court na kriminal konspiresi and theft as im join bodi wit anoda pesin go snach pesin handbag.
As Usman no dinai di ofens fo court, na im di judge wey bi Ado Ahmed kom sentens am to 2 month insaid prizin, wit opshon say if im no won go prizin, mek pe N2000 fain.
Bifo dis wan, di prosekuto wey bi nwii Mrs Agnes Adewunmi-Aluko don tel di court se na on March 24 na im wan Nnaona Chidera kom ripot fo Bwari Police Station se Usman and Ifeanyi Ogbonna wey don ron snach im bag wey bi se na a Tecno fone wey im bai N17, 000, pawa bank wey im bai N3, 000, im Secondary School second term result sheet and N4,000 kash dey insaid.
Di prosekuto kom tel di judge se di law wey kach Usman na sekshon 97 and 287 of Naija Penal Code.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.