Long taim Nollywood akto Jide Kosoko don tok se im no bin nou se im waif Henrietta Kosoko don dai ontil sombodi kom sho am di tori fo internet.
Kosoko wey don los 3 waif inside 24 yiez tok se wen di pesin sho am di tatafo niuz abaut im waif waka, im nor biliv o.
Fo October 1992 and November 1993,Kosoko los 2 of im waif dem.
Nau im kom dey wori se pipul go dey rekod am fo am se im don los 3 waif.
"Na nomba 3 waif wey a don los bi dis. Pipul go dey tok. Dem go dey kaunt am. A no ondastand dis kain tin," im kom dey krai.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.