Monday, June 13, 2016

Si piksho from Naked Restaurant fo London

Naija pipul, tins de hapun o. London don get dia fest naked restorant and dem kol am N@.kked Restaurant.

Fo dat ples, dem no de wia klot chop. Na jos fiu dez don pas we dem opun dis N@.kked of a ples bot 46,000 pipul oredi don rait dia nem fo list se dem wn go chop dia.

Bot if yu tink se yu fit go dia du eni hau, na sori bi yo nem. As dem rait insaid dia "rules of engagement" we dem de giv eni kostoma we kom dia, dem no de alau minimini wanawana fo dat ples.

If yu jos enta, yu go komot ol yo klot, kom sidon jeje chop yo fud. If yu kari yo patna go dia, una go de neked chop, drink bot una no go du enitin onto minimini wanawana levul.

Na N@.kked bi dat fo yu. Abeg enjoi piksho.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories