Monday, June 13, 2016

Aisha Buhari go tek kia of pikin we im heart de autsaid bodi (piksho)

Dat bebi boi we im mama born wit im heart autsaid, im lok don shain o.

Wai bikos Aisha Buhari we bi waif of di Prezident don tok se shi go pe di moni we dem go yuz giv am tritment.

Na dat ha pet projekt we bi Future Assured shi go kari du dis beta wok.

Zahra Buhari na im shia dis gud niuz fo Twitter.

Doktos bin tok se na laik N2m to N3m dem go yuz du opreshon fo di boi so dat im heart go de insaid bodi laik oda pikin dem.

Bifo di doktos go du dia wok, mek una si fo piksho, hau i bi fo di smol pikin.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories