Diego Maradona don tok se im kontri man we bi Lionel Messi no get di pesonaliti and karakta we evri leader sopoz to get.
Na on Thursday fo Paris wen im de du tatafo wit Pele na im Maradona tok dis wan o.
Pele bin ask im felo World Cup wina weda im sabi im kontri man rich graund.
Na im Maradona jos opun im maut bigin tok o.
"Im bi beta pesin o, bot im no get pesonaliti," na so Maradona tok.
"Im de lak di karakta to bi a leader."
Na im Pele kom respond: "Ah, a get am. Im no bi laik wi bi bak in di dez. In di 70s wi [Brazil] bin get korekt korekt pleya dem laik Rivellino, Gerson, Tostao.
"No bi laik Argentina nau , we de depend onli on Messi."
Na im Maradona kom tok se, "Messi korekt pleya , a no de doubt am, bot im no get pesonaliti."
Di Olympic gold medal we Messi bin win fo 2008 na di onli mejo midal we im don win wit Argentina.
Na fo Barcelona im jos de win ol im tins.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.