On Satude, June 11 araund afta 3 in di aftanun na im wan krez wuman we nobodi sabi ha nem bigin born pikin fo Marian Road insaid Calabar, Cross River State.
Wan aiwitnes we bi Ofon Umoh we get shop araund dia tok se dem don de si di wuman araund di ples, ivun bifo shi get bele.
"Wi don de si ha fes fo eria, bot afta som taim, wi no kom si am agen. As shi kom sho fo eria agen, na wit bele.
"Onli som dez ego na im shi riton fo dat spot wia shi sidon born di pikin.
"Wi jos obsav se shi de du wan kain, bot as nobodi bin de tok to am, wi no kom nou se na pikin shi wn born o.
"As di pikin hed bigin sho, na im pipul ron go kol helt wokas we kom help am. "
Naija Languej hie se na di Cross River State Commissioner fo Health, Dr. Inyang Asibong kom bai hasef kari dis krez wuman wit ha pikin go Calabar General Hospital.
Si Dr Asibong wit mama and pikin fo piksho.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.