Wan amroba we no wn repent we kol imsef Samuel Meme don go rob wan oyibo hosband and waif insaid dia moto fo Lagos trafik.
Dis oyibo pipul na from Portugal. Na polis from Rapid Response Squad kach dis 22 yiez old amroba we bi se i neva tey wen im komot fo kirikiri prizin fo Marine Bridge, Ijora afta im don rob di oyibo pipul and anoda pesin fo trafik.
Dis tif from Delta State tok se im de olwes taget pipul we de bizi wit dia fon insaid moto.
“Na 6 wi bin de fo mai gang. Bot 4 of os we bi Gbenga, Imele, Tontolo and Lateef de fo kirikiri prizin nau.
"A jos de kom bak from Kirikiri maisef and na 3 mont a spend dia.
“Wi de rob eni moto we bi se di pipul insaid de pres dia fon. Araund 8 oklok in di nait na im wi de stat opreshon.
“Mai plan dat nait bi se na onli mi go go tif. Bot as a de plan to straik, a kom si mai frend Wasiu we bin tich mi hau to rob. Wi kom disaid se na moto wi go rob dat nait.
"Dat taim, go slo de we long rich Marine Bridge.
“Wi kom atak wan Toyota SUV we 2 oyibo pipul de insaid, and a kom rizin am se na hosband and waif bi dat. Mi and Wasiu pozishon fo ich said of di moto and wi kom brek di 2 bak glas dem.
“As a kolekt di man fon, Wasiu grab im waif fon and 'purse' we N60,000 de insaid. Di wuman kom de beg fo ha medisin from di 'purse', so a kom tel Wasiu mek im kari am giv am. Na so wi komot dia go rob anoda moto."
Di next moto we dem rob na
Toyota Corolla bot afta dem don brek di glas kom si se di wuman dia no get moni, dem kari ha handbag and 'jewelry'.
As dem wn komot from dia go du anoda wan, na im RRS polis we de patrol di eria kach Meme o.
Im koch we bi Wasiu eskep.
Durin di taim we polis de kweshon am, Meme konfes se im sabi tif trela batri wel wel.
Im kom tel polis im bin sel 5 moto batri we im tif to wan Musa Yahuu foN5,000 ich.
Naija Languej hie se police don arest Yahuu bikos of tif tif propati we dem de akiuz am se im de bai.
Police Public Relations Officer, SP Dolapo Badmos don konfam di tori.
“Di kes na konfam. Dem don kari di sospekt go Special Anti-Robbery Squad, SARS fo mou tochlaitin. Amroba dem no go si ples to haid fo Lagos."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.