Afta 9 days wey wan Peace Mass Transit moto go jam trela kom kil 13 pipul fo Umuahia, anoda wan don enta bush o.
Una go rimemba say fo di wan wey bin hapun on Sunday May 22, afta di Peace Mass Transit moto go jam trela insaid hevi ren, na 13 dai aut of di 15 pasinja wey dey insaid di moto. Ivun di draiva folo dai.
I no kom tey agen (onli 9 dez), anoda Peace Mass Transit moto kom fombul fo road.
Dis taim na fo Enugu-Abakaliki road na im di moto liv road kom enta bush o.
Peace Mass Transit, i bi laik say una draiva dem don dey do enihau fo road. Mek una trai kontrol dem abeg.
Si di piksho fo di tu aksident dem.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.