Wednesday, June 1, 2016

Na Boko Haram bring tomato skasiti - Lai Mohammed

Di Minister of Information and Culture wey bi Lai Mohammed tok se na bikos of Boko Haram tomato no dey fo maket.

Mohammed tok fo Channels Television se Boko Haram don poshu ol di tomato fama dem komot fo Northeast.

"Pipul dey tok se tomato tu kost fo maket bot dem foget se sins 2 yiez, Boko Haram no let famas enta bush go fam tomato and oda tins dem.

"Ol di pipul wey dey raid okada fo Lagos na pipul wey sopoz to dey vilej dey fam," na so im tok.

On top dat wan, Mohammed tok se "ivun sef beta ren neva fol sins last yie. Na ol dis tins join hand mek tomato no dey fo maket. If yu tink se a dey lai, go ask economists and agriculturists dem."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories