Abisola Kola-Daisi na di dota of bifo bifo govano of Oyo State.
I neva tey wey shi go wan birthday pati fo Lagos wey bi se na big men dia pikin dem kom dia.
Di pesin wey du di birthday na wan big man pikin wey im nem na Jennifer Obayuwana.
Bot di tori bi se di dres wey Abisola wia go di pati, na £2940 shi bai am.
If yu kom chej am tu Naija moni, na N1.4m bi dat o.
Dis dres, dem tok say i get som kain preshos ston wey dem tek arenj am.
Abeg kari yo aiz si beta tin fo piksho.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.