Tuesday, May 31, 2016

Si bag wey pesin bai $300,000 (piksho)

Wan handbag don brek wold rekod o, say na im dey ekspensiv pas evri oda handbag.

Dis bag, na white diamond with 18 karat white gold and krokodai skin dem tek mek am o.

As wan shop wey dia nem bi Christie kom sel dis bag on Monday fo $300,168 to wan Asian pesin wey bi say im oun na to dey kolekt kostli kostli tins, na so im kom brek di wold rekod o.

Wai bikos nobodi don eva pe dat kain moni for handbag bifo.

Christie wey bi di shop wey bin okshon di bag tok se di kain diamond wey dem kari du di bag, na onli 1 ou 2 dem dey produs evri yie.

Dat wan min se dat diamond wey dem dey kol Himalayan Diamond i nor izi to get o.

Si di handbag fo piksho hie.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories