Tuesday, May 31, 2016

Si ol di propati of Kola Aluko and Jide Omokore wey court bin siz

Last wik, wan Federal High Court giv order se mek Naija govament siz di propati of 2 Naija biznes man dem wey dia nem bi Kola Aluko and Jide Omokore and dia kompeni wey bi Atlantic Energy.

Dem tok se dis 2 pipul and dia kompeni folo bakyad go kolekt kontrakt from bifo bifo Petroleum Minister wey bi Diezani Alison-Madueke.

From dis bakyad biznes, dem kom pak hevi moni go bai difrent difrent propati dem wey rish $1.8b fo difrent difrent kontri dem.

Nau Court don giv Naija govament pawa to siz ol doz propati.

Mek una si di list of di propati dem.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories