Tuesday, May 31, 2016

DNA konfam say na Wizkid bi di papa of anoda pikin

I bi laik say Wizkid don fada anoda pikin wit anoda wuman o. Tatafo pipul don dey tok am se wan Guinea wuman wey bi Binta Diamond Diallo born pikin fo Wizkid bot di Naija muzishan no konfam di tori and im no dinai am.

Diallo sef kom kari Wizkid nem giv di bebi boi so dat im no go dinai se na im born am.

Nau di rizot of di DNA test wey dem du don konfam say tru tru, na Wizkid bi di papa of di pikin.

Na Diamond Binta Diallo wey bi mama of di pikin kari di rizot wit ha pikin piksho dem kom put fo Instagram o. Shi kom rait onda di piksho se "DNA nor dey lai. Dis wan no bi rumor. Put aiz fo graund mek yu si am." 


Mek una si di piksho dem wey im post.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories