Sunday, June 5, 2016

Oga Jona don travul agen

Smol taim wen im riton from im long holiday fo Cote D'ivoire, bifo bifo Naija President, Oga Goodluck Jonathan don travul aut agen.

Dis taim araund, dem se Oga Jona go United Kingdom wia im go giv som tok and intaviu.

Jos last wik, Oga Jona bin enta Aso Rock to diskos Niger Delta militant wahala wit Baba Buhari.
As i bi nau, som pipul tok se dem si Oga Jona fo London Heathrow Airport wit im bifo bifo Special Adviser on New Media wey bi Reno Omokri.

Si Jona wit Reno fo piksho.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories