Muslim yut niali komot wan kapinta aiz fo Kaduna on Tuesday bikos dem si am dey chop durin Ramadan fastin.
Di 41 yiez old man wey im nem bi Emmanuel Francis se im dey im wokin ples de chop wen 6 Muslim bois kom mit am.
Im say as dem ask am weda im bi Christian ou Muslim, im nor ansa dem.
Bot wen dem ask wai im dey chop fo fastin taim, im tel dem se im no bi Muslim o.
Bifo im nou wetin dey hapun, dem don dey chuk am wit naif, sizos and kotlas sotay i rimen smol mek dem komot im rait ai.
Francis kom tel Govano Nasir El-Rufai fo im hospital bed fo St Gerrard Hospital se as im bin fent, im nor ivun nou hu kari am kom hospital.
Na Sokoto road fo Kakuri eria na im dis tin bin hapun o.
Una go rimemba se i neva tey wey som Muslim yut go kil wan Igbo wuman fo Kano wey dem tok se shi yab dia relijon.
Dis na beta nius wen kari bad nem fo ol Muslim pipul. Dis na yeye wen nobodi wn tek iye hia.
ReplyDeleteTank yu as yu mek os si dis.