On Thursday na im fedral govament tel Naija pipul and forin pipul se bai di yie 2025, nobodi go dey shit fo opun ples fo Naija.
Di Minista of Water Resources, Engr. Suleiman Adamu, na im tok di wan durin di taim wey Govano of Ebonyi State wey bi Dave Umahi visit am fo ofis.
Afta im tok dis wan finish, di Minista kom promis govano Umahi se im go help am provaid wota fo Ebonyi pipul.
Dem go fit stop dis kain tin fo Naija so? Abi eria bois and almajiri dem no go dey Naija bai 2025? Wot of babanbola and mai baro dem wey no dey get haus? Wia dem go poshu dem go bai dat taim?.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.