Jostis Oluwatoyin Ipaye wey dey Ikeja High Court don sentens wan bifo bifo banka Olawale Garuba, to 39 yiez insaid prizin bikos of di moni wey im bin tif from di akaunt of wan bank kostoma wey don dai.
As shi tochlait di mata finish, Jostis Ipaye kom faind Garuba giulti fo ol di 13 ofens wey dem chaj am wit.
As ich of di ofens kari 3 yiez fo prizin, na im bi se Garuba sopoz to go chop beans wey no don insaid prizin fo 39 yiez.
Bot enihau, im kom dey loky se na di sem taim im go sav ol di prizin sentens, minin se na onli 3 yiez im go dey prizin.
Garuba dey go prizin 1 yie afta dem kari am go court se im tif dead kostoma moni. Ol di ofens wey dem chaj am na onda sekshon 285 (sobsekshon1) insaid kriminal Law fo Lagos State 2011 na im govament tok di ponishment wey dem go giv am.
Bifo bifo, Garuba bin dey dinai se im no du di badness bot afta 1 yie wey dem don dey trai am fo court, im kom gree se tru tru im komit di ofens.
Di oda 5 pipul wey EFCC tok se dem join bodi wit Garuba du di badness stil dey dinai se dem nor folo chuk finga insaid oyel.
Di pipul wey stil dey tel court se dem nor folo Garuba lik oyel na Festus Onile; Abiodun Afainiya; Jayeola Afolabi David; Yewande Adeyemi and Adetoun Kammal.
Di bin kol EFCC to kach dis sospekt dem afta dem notis se dem don dey yuz wuruwuru moni transfa plos ATM kad and POS meshin to tif mou dan N31m from di dead pesin akaunt.
Afta Olanrewaju Ajanaku wey bi Garuba im louya don beg di court to tempa jostis wit mesi bikos of di yong waif and 2 smol pikin wey im get, di judge se im nor fit du dat wan o.
Shi kom ask Garuba se hau yu go alau yo long-throat to kontrol yu sotay yu go de tif dead pesin moni? Moni wey bi se dat pesin famili sopoz to kari tek kia of demsef. Dis tin wey yu du na sirios wikednes and a no go tempa jostis wit mesi.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.