So yu tink se yo pikin fat? Ok nau, kom and si di won we sinio Beatrice.
Di wold rekod holda fo pikin we fat pas na 10 yiez old Arya Permana. Im de klok 192 kg fo scale.
Bikos of im hevi wet, Arya no de fit waka wit im leg bot im de sidon fo won ples finish fud we tu adolt pipul sopoz to chop.
Di papa and mama of dis boi tok say im de chop 5 taims evride. And eni fud we yu wn giv am, rice, fish, beef, vejitebul sup and soya go de dia, odawaiz im no go gri chop am.
Bikos of im big saiz, Arya no de wia klot fo bodi. Im jos de manej tai rapa fo west. Na evritaim hongri de kach am.
Arya no de go skul bikos im no fit muv imsef araund. Ivun to breath de had am.
Hie wetin im mama tok.
“Mai pikin de chop tu moch and onli him de chop tu adolt pipul fud fo won ples.
“Im de olwes taya and i no de breath wel. Na onli to chop and slip bi im oun. Afta dat won, na to enta bafrum sidon insaid wota fo meni awas. Dis kain fat we mai pikin de fat eh, a de fia fo im health o."
Si Arya Permana fo piksho.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.