Thursday, June 30, 2016

Peace Mass Transit don finish pipul fo anoda aksident (si piksho)

Wan Peace Mass Transit bus we de travul from Enugu to Bayelsa Stet don jam fes to fes wit big trok fo anoda sirios aksident o. Dis won hapun fo Okogbe town, along Emezi Road.

Som pipul we de araund tok say afta di aksident hapun som pipul kari pent kom de kova di nem of di kompeni fo di bos, bot as dem si se pipul don de gada, dem ron komot.

Won aiwitnes tok se evribodi insaid di bos dai, bot anoda pesin say i get won bebi we sovaiv.

Yu go rimemba se i neva tey we won Peace Mass Transit moto jam trela fo Umuahia kom kil 13 pipul. Smol taim afta dat aksident, anoda Peace Mass moto enta bush fo Abakaliki rod. Nau dis won don hapun agen.

Si di aksident fo piksho.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories