Thursday, June 30, 2016

N2.1b arms moni: Metuh don taya fo court wahala, wn rifond N400m

Di Publicity Secretary of di Peoples Democratic Party, PDP bifo, Chief Olisa Metuh tok se im don taya fo court wahala.

Fo dat rizin, im don agri se im go pe bak di N400m we im bin kolekt from di N2.1b arms moni.

Di N2.1b na moni we dem sopoz to kari bai wipon fo Naija armed forces dem bot som pipul jos kona am go de ple politiks wit am.

Metuh say im de tok wit Ministry of Justice, EFCC and oda pipul we dia maut rich di mata so dat im go riton di moni go rest fo im haus.

Metuh loya we bi Onyechi Ikpeazu SAN bin tok ol dis tins fo di stetment we im riliz on Thursday.

I tok say ivun dou na Oga Jona bin giv Metuh di N400m and im kari am go di mesej we dem send am, im go trai im best to pe am bak.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories