Police fo Kano tok se pipul wey dem sospekt se na kidnapas don kari wan boi by fos go slota am laik ram o.
Oga tok tok fo Kano Police Command, DSP Magaji Musa Majia di boi wey dem kol im nem Musa Salisu bin go mesej wey im papa send fo Naibawa Quarters araund dat kain 2pm bot im no kom riton di taim wen im sopoz to riton.
Eni hau, Majia tok se dem don grab 2 pipul wen i bi laik say dem get hand fo wetin hapun to dis 11 yiez old praimari 6 boi.
Di smol boi onkul wey bi Abubakar Kafinta tel tori pipul se di kidnapas bin tok se if dem nor pe N500,000, dem go slota di boi. And tru tru as di moni no kom, dis bad pipul kot im trot laik say na ram.
Kafinta say dem stil dey faind di ransom moni wen di kidnapa pipul fone dem kom tel dem wia dem trowe di boi bodi.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.