Nollywood akto and bifo bifo president of Association of Nigerian Theatre Arts Practitioners, ANTP, Prince Jide Kosoko dey krai nau o as wan of im waif don dai.
Dem se Henrietta Kosoko wey bi jos 53 yiez jos fol daun fo dia haus on Monday monin. Bifo dem nou wetin dey hapun, di wuman don dai o.
As dem kari am rish hospital, na im dokto konfam say shi don dai.
Ivun di wuman dota dem wey bi Shola and Bidemi go dia palle Facebook page go konfam di tori.
"Henrietta Kosoko don dai. Mama wi dey mis yu. Mek yo sol faind korekt rest."
Famili pipul say i don tey wey Henrietta dey strogul wit diabetes o.
As Henrietta Kosoko wey bi se shi don dey akt bifo Jide mari am don dai so, na im bi se Nollywood don luz anoda talent bi dat.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.