Monday, June 6, 2016

Colombia koch tel James to komot fo Real Madrid

Bifo bifo Colombia koch wey bi Hernan Gomez don tok se James Rodriguez no go si futbol ple onda niu Real Madrid koch Zinedine Zidane.

Sins January wey Zidane bikom oga fo Madrid, im nor dey tu selekt di 24 year-old pleya wey bi se dem bai am $123.46m from Monaco in 2014.

Tatafo pipul don dey tok se im go komot fo di klob go join Manchester United ou oda klob dem, bot James kom tok last mont se im go rimen fo Madrid to fait fo im oun shet .

Bot Gomez kom tel WIN Sports se, "a go giv James korekt advais. I go beta fo am mek im komot fo Real Madrid as di koch don sho se im no won ple am.

" Im na wold-klas pleya and im get to go anoda klob. Na awa best pleya im bi and wi nor laik to si am dey sidon fo bench. As im oga nor dey selekt am fo mach, mi a nor laik am. "

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories