Tuesday, June 7, 2016

Hau Civil Defense kach militant oga fo Naija Delta

Wan of di gang memba dem fo militant wey bin atak Agip paiplain fo Niger Delta last wik don enta Civil Defense hand o.

Dis sospekt wey dem kach so, wey im nem na Suoyo Nathan na im bi di oga of di militant dem wey bomb Tebidaba-Brass trunkline araund Ikienghenbiri vilej fo Southern Ijaw Local Government Area of Bayelsa State.

Dem se na im dey fo front wey odas dey folo am fo bak.

Dem se na insaid swamp Civil Defense go kach dis militant oga laik crab o. And dem stil dey faind two of im kolig dem wey manej to eskep. Doz wans, dem dey kol dem Iyalawei and Fyneboy.

Pipul wey dey di komuniti se na faita jet wit gunboat and helikopta govament kari dey patrol di eria.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories