Sunday, June 12, 2016

Flavour Nabania na Life Continental Beer brand ambasado

Di bigest beer kompeni fo Naija, we bi Nigeria Breweries Plc don kari hiplife muzik meka we bi Flavour Nabania as dia brand ambasado fo Life Continental Beer.

Naija Languej hie se dem giv Flavour di job bikos Igbo pipul de drink Life Continental Beer no bi smol.

As i don tey we Igbo man de drink Life Continental Beer, na im di kompeni se if dem put Igbo man fes fo dia advat, Igbo pipul go nou se tru tru, dis beer na dia oun.

Durin di pres konfrens we dem du to anauns se na Flavour bi dia ambasado, di Corporate Affairs Adviser, Nigerian Breweries Plc, Kufre Ekanem tok laik dis :

"I swit awa bele tode to anauns se Flavour Nabania don join Life Continental Beer famili as brand ambasado. Flavour na pesin we di hol wold nou se im de sing fo Igbo languej wel wel, and na im bi di best pesin to sho wetin di brand stand fo."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories