Bifo bifo oga of militant dem, Hai Chif Government Ekpemupolo we im popular nem na Tompolo de hala se Naija soja dem we enta Gbaramatu Kindgom last mont neva riton di simbul of otoriti of Egbesu shrine, dia Ijaw we dem bin kari komot.
Tompolo kom de krai se soja dem kari Egbesu propati komot fo shrain durin dia inveshon of Gbaramatu on May 28.
Hie wetin im tok.
"A neva hie bifo ou ivun tek mai aiz si, ivun fo Northeast we Boko Haram de kil pipul enihau, se soja dem go enta wia pipul de woship go komit abomineshon as dis army pipul kom du fo Gbaramatu Kingdom."
Tompolo we im tradishonal taitul na Ibeebidouwei of Ijaw Nation kom tok agen se ol di pipul fo Gbaramatu don ron komot, as dem de fia se di tin we Naija army du dia fo 2009 fit hapun agen fo 2016.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.