Di pastor of stomach infrastructure ministri wey bi Govano Ayodele Fayose fo Ekiti State no ivun kia abaut di hevi ren di oda de as im jos dey shia rice to im pipul dey go as ren dey fol.
I don tay wey Govano Fayose wey bi di faunda of di ministri wen im kol "stomach infrastructure outreach" don dey dash Ekiti pipul awuf fud o.
Yestade na im wan kain hevi ren fol fo Okeyinmi eria fo Ado Ekiti, bot dat wan nor stop Fayose as im enta di ren kom dey shia rice to ol doz pipul dem wey nor get N13,000 to bai wan bag of rice.
Oya nau, mek una si Fayose as im kari umbrella dey shia stomach infrastructure insaid ren.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.