Araund 3.6m chidren we no si fud chop na im dem trit kwashiokor fo Kano onda di Community Management of Acute Malnutrition (CMAM) program we UNICEF don de du dia sins 2010.
Hajiya Halima Musa we bi Nutrition Officer, Kano State Ministry of Health tok dis wan durin di field waka we shi du wit niuz tori pipul fo Sharada Primary Health Center, Kano,. Na UNICEF bin arenj dis waka on Thursday.
Di waka na fo sho niuz pipul from Kano, Katsina, Sokoto, Taraba, Lagos, Abuja, Kaduna, Gombe, Bauchi, Plateau, Adamawa and Jigawa, hau dem de kontrol kwashiokor fo di state.
Shi tok se dem get 30 senta wia dem de trit pipul we no de chop beta fud insaid siks lokal govament fo di stet.
Musa say na103,376 kwashiokor pikin dem trit fo ol di senta dem fo 2015.
Shi stil tok se 5,744 sik pipul na im dem admit we bi se 9 of dem bin dai fo dat piriod.
As Musa tok, 1,617 sik pipul don rikova ivun dou 272 of dem no folo dia tritment as dem sopoz to.
Akodin to Musa , wan senta de handful laik 80 ou100 peshent evride.
Shi kom tok agen se na awuf Ready to Use Therapy Food (RTUF) dem de giv ol dis kwashiokor pikin dem.
Shi kom beg mek dem put di tritment senta dem fo 22 lokal govament eria fo di stet to help mou pipul we kwashiokor de wori.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.