Prezident Buhari go stil spend som dez fo London afta im don finish im tritment dia. Na wetin Vais Prezident Yemi Osinbajo tok bi dat.
"Oga Prezident de kom bak on Sunday. Mi a tok wit am and a tink se i beta mek im yuz di wikend rest." Na so Osinbajo tel tori pipul fo Abuja.
Na on June 6 Buhari go London to si dokto fo di tin we de wori am fo iye. Na on Thursday June 16 im sopoz to riton.
Osinbajo say Buhari don wel and im go rizum wok on Monday.
"Mista Prezident de kampe. Im don rikova and im de redi fo wok."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.