Sunday, June 5, 2016

Dem dey miks kerosene wit petrol fo Borno

Nigerian Security and Civil Defense Corps, NSCDC don tel Borno pipul mek dem bi kiaful as som bad pipul don dey miks kerosene wit petrol de sel.

Na on Sunday wey Ibrahim Abdullahi wey bi NSCDC Commandant fo Borno State to dis wan fo Maiduguri as im dey yan wit News Agency of Nigeria, NAN.

"Pipul don dey kol dey tel os dis tin. Wan man fo Moduganari se im haus niali kach faya wen im trai to yuz di bad kero.

"I sopraiz os se pipul fit miks kerosene wit petrol kom de sel fo maket.

"Wi neva nou weda na Boko Haram dey du dis badness bot wi stil dey tochlait di mata."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories