Wednesday, June 1, 2016

Amaechi don test-draiv Abuja-Kaduna train (piksho)

Si hau Minister of Transportation wey Rotimi Amaechi dey enjoi insaid Abuja-Kaduna train.

Bot as i bi se na onli test im go test di train, im jos raid am from Idu steshon go rish Kubwa.

Afta im don test-raid di train finish, im kom tok se na fo 1st wik of July na im Baba Buhari go komishon di train. From dat taim, pipul go dey folo di train go Kaduna

As di minista tok, na 1000 police go dey protekt di train and pasinja dem.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories