Na bikos dis 4 yiez old smol girl wey dey nosri skul bin fel asainment fo klas na im tisha flog am laik se tumoro no dey.
Wan man wey im nem na SirLuggard na im shia di tori wit piksho fo Instagram.
Si wetin im tok.
"Abeg a won mek di wold hie dis tori. I dey pen mi wela. As a si wetin dem du dis smol girl, wota komot fo mai aiz.
"Di wuman wey dey top rait fo di piksho na im bi tisha wey flog di smol girl laik se tumoro no dey bikos im fel asainment fo klas.
"Di tisha nem na Mrs Eno. Di madam wey get di skul na Mrs Lagunoke.
"Di skul na Lydia Spring Private School fo Popo Street, Tejuosho, Yaba, Lagos.
"Di smol girl fes swel op and im eye red as dem flog am fo eye.
"Nobodi sopoz to flog pesin pikin laik dis sek of say dey won tish am fo skul. Dis kain tin bad.
"Ivun sef, Mrs Eno wey flog pesin pikin fo eye and Mrs Lagunoke wey get di skul nor dey sori for wetin hapun.
"Enitin wey una fit du mek dis pipul smel pepe fo wetin dem du dis smol girl go swit mai bele.
"Di smol girl mama na mai frend and nebor. I dey pen mi wela to dey si dem dey krai evritaim bikos of hau di girl dey sofa.
"A salut una."
Posted by SirLuggard (@lurdluggard) on May 29, 2016
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.