Dis man wey dey sow cloth fo big big pipul dem los im fon and na dia im girlfriend nomba dey.
Fest of ol, im nem na Malivelihood bot dem born am as Michael Awojuola.
So as im no fit rimemba di nomba and im girlfriend wey bi Deola Smart nor gri giv am, im kom dey beg se enibodi wey fit help am wit Deola fon nomba, im go dash am $25,000.
Oya nau, if yu get di girl nomba, na yo chans bi dis. Moni don kom.
See di girl piksho wey im post fo Instagram.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.