Monday, May 30, 2016

Bad pipul wey kidnap LUTH dokto don kill am

Som bad bad pipul wey go kidnap wan dokto wey bin dey wok fo Lagos University Teaching Hospital, LUTH fo im vilej on Sunday don kil di man o.

Punch Metro tok se Dr Adekoya-Cole wey bi 60 yiez na Consultant Orthopedic Surgeon fo LUTH.

Dem tok se Dr Adekoya-Cole dey atend wan lokal seremoni fo im vilej fo Ijebu Ode wen dis pipul go kil am.

Nius tori pipul hie se dem go kidnap Dr Adekoya-Cole fo im haus fo vilej.

Afta dat wan, dem kom kari kotlas kom kot kot di man bodi sotay im kom dai.

Di Police tok tok pesin fo Ogun State wey bi DSP Muyiwa Adejobi don konfam di tori.

Adejobi kom tok se police don kach 8 pipul wey dem tink se dia hand dey insaid dis badness wey hapun.

Som pipul wey dey di don yan se na wan vilej ritual di dokto kom join im kinsmen du on Saturday.
As kasala kom borst fo di ritual on Saturday, som yeye pipul wey dem dey kol hoodlums kil wan juju dokto.

As dem kil di juju dokto so, na im som oda pipul vex go kil di oyibo dokto.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories