Wan 37 yiez old man wey im nem na Ibrahim Abu go spend di nes 6 mont insaid prizin bikos im yuz bai fos go toch di brest of wan 17 yiez old girl wey dem no tok ha nem.
Magistrate Osunsanmi wey dey ron tins fo Ikeja Magistrate Court na im send Abu go prizin las Friday fo wetin oyibo dey kol sexual assault wey im bin komit las wik Monday.
Abu, wey im haus dey fo nomba 6, Mosque Close, Isheri-Olofin, Lagos State, bin go blok di girl fo Baale Bus Stop Akowonjo, araund 7.30 in di nait, kom dey toch toch ha brest bai fos.
As di girl vex slap Abu, na im kari plank nak am fo hed. Na so di girl kom fent o, bifo pipul kom rosh am go hospital.
Leta leta na im police kom arest Abu kom hand am ova to
Domestic, Sexual Violence Response Team wey bi DSVRT.
As di judge won send Abu go prizin so, im kom tel am se di law wey kach am na Section 135 fo di Criminal Laws of Lagos State, 2011.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.