Saudi Arabia govament don kil wan Naija man wey kil wan polis ofisa fo dia kontri.
Dat kom mek nomba 95 fo pipul wey Saudi govament don kil dis yie fo som bad bad tins wey dem du.
On Sunday na im dem kil Fahd Houssawi afta court don konfam say na im kil wan polis man wey dem dey kol Abdul-Ghani Al-Thubaity.
Interior Ministry fo Saudi Arabia tok se Houssawi kari korekt blo nok di polis man daun. Laik say dat wan nor du am, im kom dey nak di polis man hed fo graund sotey di man kom dai.
As Houssawi won kom eskep afta im don kil pesin finish, im stil go wunjor anoda polis man wey bin wan arest am.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.