Tuesday, May 31, 2016

Wetin kil Abacha na im kil Abiola - Al-Mustapha

Bifo bifo Chief Security Officer, CSO fo Head of State wey don dai, Gen Sani Abacha wey bi Hamza Al-Mustapha don yan se im go sun tok di tin wey kil im oga and di man wey win June 12, 1993 elekshon wey bi MKO Abiola.

Na on Monday Al-Mustapha tel tori pipul fo Lagos se di tin wey kil Abacha and di tin wey kil Abiola na from di sem ples o.

As tori pipul kom ask am wia di tin bin kom from, Al-Mustapha se na di taim wen im go lonch im buk wey im kol Mustapha's Memoirs im go ekspos evri evri fo di mata.

"Dat tin wey kil Abacha, na im kil Abiola. Bot a no go tok am nau. Na afta dem don finish mai mata wey stil dey Supreme Court a go tok. Dat taim, a go olso poblish mai buk wen a kol Mustapha's Memoirs.  Na dia a go tok evritin wey hapun fo Abacha govament and hau im tek dai."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories