Chief Ayo Adebanjo we bi big man fo Afenifere don tok say ol di yans we Minista of Infomeshon Lai Mohammed and Baba Buhari SA on Media de yan on top Mr Prezident health na yawa.
Adebanjo bin tel Punch se wetin dis tu pipul de tok no mek sens at ol.
"A bin hie Lai Mohammed tok las nait se Buhari de kampe. Yu si dis kain tok? Pesin go holidez fo 10 dez fo UK and wen taim rich to riton kom stat wok, im no fit kom bak. Dat won no tel yu se tins don get as i bi?
"Afta, dem kom tok se dokto say mek Buhari sidon du mou test. Femi Adeshina say di man de du test. Lai Mohammed say di man de kampe. Hau manej?
"Dis kain tok no get as i bi? Abi dem de du test fo pesin we de kampe? Mi a no bi mumu o and a nou se Naija pipul no bi mumu.
"Nobodi de pre bad preya fo Baba Buhari bot mek dem tel os tru tru wetin de hapun to awa prezident. "
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.