"Tode, a don disaid mek a tok fo maisef. A no bi tif. A no fit bi tif. Tode na di day we dem tok se mek a kom giv God testimoni. Fo di pipul we sabi mi, una nou se ivun mai laif sef na testimoni. A de tok am evritaim se na God fashion mai laif, kom pakej mi, kom bles mi
"Di taim we mai trobul stat, a no wori abaut maisef bikos a nou se God stand wit mi. Wetin wori mi dat taim na di sofa we mai pipul go sofa.
"A bin nou se won de won de, a go kom bak and a tank God se a don kom bak. As a kari mai aiz korokoro kom de luk ol of una fes we a don de mis sins, mai bele swit no bi smol.
"A no go tok plenti tok nau bikos tode na to tank God se im hie ol di preya we una pre fo mi.. Won de a go kari mai maut tel una wetin dem tek mai ai si. Bot fo nau, mek wi de enjoi de go. Notin spoil."
Ol dis tok na wetin di govano of Delta Stet bifo bifo we bi James Onanefe Ibori bin tok on Sunday wen im du thanks giving fo First Baptist Church, Oghara.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.