Sunday, February 19, 2017

Dat Fedral Govament plan to ban okada de wicked o - Fayose

Govano of Ekiti Stet, Ayodele Fayose don tok say dat plan bai Fedral Govament to ban okada motorcycle evriwia fo Nigeria na konfam wikednes.

"A no go ban okada fo Ekiti Stet bikos na wetin meni famili de kari fid diasef. Hau pesin go ivun tink dat kain tin wen govament neva ivun faind anoda emploiment fo dem.

"Fo dis riseshon piriod we hongri de evriwia na im pesin get maind to say im go stop okada pipul biznes?"

Fayose bin tok on Saturday fo Ikere Ekiti wen im de yan wit okada pipul we kom grit am as im de riton from Abuja.
.
Di govano tok se im go kontiniu to de sopot okada pipul fo Ekiti Stet as fa as dem no brek di law.

"Fedral Govament no get eni pawa to ban okada fo mai stet. Onda mai govament, nobodi go distob okada pipul fo Ekiti onles dem brek di law

"Hongri de kil pipul fo di kontri and meni of dis okada pipul na grajuet we no si wok eniwia. Som of dem ivun los dia job onda dis APC Fedral Govament. Hau FG wn mek okada pipul chop as dem wn komot fud fo dia maut?"

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories