2 gunmen we dem de sospekt se dem de haya dem to go kil pipul don go kil di vilej hed of Ikot Ansa Eneng Obong in Ukanafun Lokal Govament Eria of Akwa Ibom Stet, Chief Emmanuel Umahaeyo.
Naija Languej hie se di gunmen bin shut Umahaeyo 2 taims wit dia gun insaid im haus bifo dem tek of wit di motosaikul we dem kari kom.
Won pesin we no gri tok im nem tel niuz pipul se afta dis bad pipul don kil di chief finish, dem kom put hed fo Nkek Urua Akpan Udosen vilej wia dem kil tu pipul we dem sospekt se dem go fit espoz dia sikrit.
Polis tok-tok pesin fo Akwa Ibom we bi ASP Cordelia Nwawe don konfam di tori ivun dou shi tok se dem stil de tochlait di mata.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.